Tuesday 27 January 2015

How A Youth Corper Escaped From Being Kidnapped In Abuja Yesterday

Make una help me thank God oo.. I'm a batch C youth corper posted to abuja but not yet serving oo, I was rejected last week by a govt office that wasted over 3weeks of my time due to come back next week talk before I was issued a rejection letter on friday. Was sadened through out the weekend but hoped on God this week shall be fruitful.



Monday morning (yesterday) stepped out on my ironed 4 over 7khaki combinations with the mind of combing the nooks & cranny of abuja streets till I get a PPA as abuja NYSC don tell us to go find PPA ourselves, naso I waka round gwarimpa, jabi,wuse 2 come enta jahi district.. All the offices & schools are either singing we already have enough corpers chorus or we don't take corpers. Entering jahi district with the last 210 naira I said to myself if this area fail to provide a PPA na swear I go swear for abuja NYSC.



Saw a very nice second school, my head swell say if I can get this place I go happy oo. Na so I start dey smile go d gate I wan enta d gate na him one angry looking security man bursted out from one lungu.. HEY!!! Otondo wetin u dey find!!!.. With my cool,calm,educated,corperish, fake abuja accent I said I'm a youth corper I want to..... HEY Mr man I'm not blind I can see u are a corper d question is What are u finding!!! Shuooo.. (Finding?? , I dare not laugh), with a smile I want to see the principal.. Are u with a formal letter?? I replied No, is he aware u are coming?? My reply, NO. So my friend move from here before I change my mind, as I be gentleman I tried to calm him down.. Naso ds man turn enta d lungu as e dey cum back na him I see dane gun for him hand.. Omo I no even double up oo I deca-hepta double my legs up ni oo.. Who wan die, with my waka about na so I see another school, d security sitdown for executive chair oo for d gate.. Na so I greet am..who u dey find? The principal.. Do u av any letter, No. Is he aware of ur coming..(Remembering d last episode, I can't let ds one slip away, God forgive me cos I'm about to lie) I answered confidently YES!!!, do u have his number?.. (Devil thank U fr bringing ds lie very fast) I misplaced it sir that's why I'm even here, corper u careless oo.. Sorry sir I muttered. But d principal neva come (by 12:25pm??), I said Oga abeg can I see the admin pple?? Ok oya go straight enter right, turn left u go see one fine office na there dem dey.. Fast-forwarded .. We need biology teacher but u studied Agric econs.. sir I can teach biology oo very well sir, I can teach anything I said to the principal after waiting for over 2 hrs.. Okay I will help u, he issued me a request letter.



Instantly I dashed out of the school gate, it was a minute past three.. With my calculations I can get to NYSC zone 3 office bfr 4pm so as to submit my letters, that will make my reposting letter to be ready by wedsday or thursday. Northerner oya carry me go gwarimpa express junction by next cash and carry. Alighting from the bike I was left with 110naira.. God how I go take do oo was d sentence racing thru my brain.. I waved down a construction hilux jeep, oga abeg help me I dey go barnex and I'm short of cash, come in was the answer I jumped in. The man said I'm heading to mabushi so u will av to drop before barnex bridge, thank u sir I'm really grateful, I dropped at d mabushi by pass, time was 3:14pm, I don calculate say with the remaining 110 I go beg any cab make he help me reach wuse with 60naira then from wuse I go see zone 3 for 50naira.. Perfect plan!! I was jugging-walking on d bridge, naso I wave a cab, wuse! Naso I enta oo.. A man was sitting at d front, 2 passengers at d backseat, one male and a dirty female(very dirty) wetin concern me with dirty na where I dey go dey my head..d dirty lady was sitting in between me and one Northerner guy at d other entrance. The following is our conversation..



Me: oga driver how much be wuse?

Driver: na 100naiara oo

Me: abeg na 60naira dey my hand oo pls help me

Driver: oooohhh.. I no dey like ds kind tin oo

Lady beside: oga driver no worry I go pay for am, na corper him be

Me: aunty thank u oo (was happy)

The driver didn't branched at barnex -wuse bypass, he was going straight with full speed...

Mesad confused) ah ah, oga driver u no know wuse road again??

Driver: I wan go pass another place hold-up fit dey dt place

Me: (was thinking is there any other place I don't know of?).

We got to airtel junction I was restless!

Lady beside: corper where u dey go?

Me: I dey go nysc office and I'm already late

Lady beside: that thing wey u wan go do no fit wait till another day?

Me: no ooo, I can't wait till another day oo, I must do it today

Lady beside: why are u so restless, d driver sabi road pass u.. So relax no worry urslf we go soon reach wuse!

My head jus correct that instant, driver pls stop ds motor I'm nt going anywhere again

Driver: see ds silly Northerner wey dey sleep inside my motor ( he parked) silly man wake!..

Lady beside: (wakes up d Northerner at d other entrance)

Driver: if I carry u pass ur bus-stop u go dey shout, now u don sleep forgt

Northernersadextend 200naira to d driver) give me change, and pls I get load for back oo

Driver: lailai I can never allow u carry that bag,u are a thief, everybody see ds mallam oo, na dollar full him bag oo.. Ask him where he see d money? Na thief he thief am.. Nobody come count bridge for abuja na share we go share d money equally!

Me: (alerted) dollars?? Full bag!! With a dollar to 210naira??, na big money oo (saying that to myslf)

Lady beside: yes na true! We go share d money, bt dis Northerner na wicked person he fit go do us evil after we share d money

Passenger in d front seat: I sabi one babalawo for apo village we go go dia go share d money and we go take OATH!!! So nobody go fit tell anybody and d Northerner no go fit do us evil

Me: OATH!!!.. I opened my door stepped down, d lady beside was holding my khaki trouser, corper neva go oo make we settle ds tin.. Settle wetin!! Na God go punish all of una .. Una be kidnapper silly people, naso I start shout ooo.. Thieves!! Kidnappers!! Thieves!!!.. Naso d driver sped off.. GOd I was a fool for being tricked to this level.. Checkin my wrist watch.. Time was 4:17pm, Jesus christ! 4 don pass...awon oloriburuku ti je kin late shaa.. I missed d submission but I thank GOd for bringing back my memory! If I had been tricked and followed them to apo village, I couldd be dead by now, at this election period! One needs to be very careful oo.. May God almighty Protect U and I from the hands of Evil..






0 comments:

Post a Comment