Thursday 12 February 2015

"My Cat Just Dey Live Like Queen o!" - OyinboPrincess (Pictures)

I hail u my people... I hope say all dey ok?



As I dey read plenty topics for this section e b like say I wan yarn small about my cat. Na this time two years ago, I don dey receive call from padi mi wey I know for work. E come tell me say this cat don become homeless... homeless sha?! how come?!



The cat don dey for one house like that, wey people nor sabi look after animals, e b like say the person head nor well at all. They don throw am for winder from 12floors high, reach ground. Omo God dey ooo - lucky say this cat nor dey break back!



Anyway sha, I don home am for one night initially - omo na almost two years don pass since!!



I don name am Tippy, na appropriately so, when u don dey think wetin happen to am. Since the time wey I don own am, omo nor b small mata.... she get one luxury fluffy bed, a personalised cushion cover, pink litter tray, cute food bowls and mat, a clawing board, a clawing tower with hiding space, toys don full the house self!!



She don tey since with these her toys ooo - I look am like... imagine na u be cat for 9ja oo - u nor go sabi anything sha. She dey lounge about anyhow, still as she don dey get all those things, she still come sleep for another place, like MY sofa!! She get big eye oo, na she dabaru!



Na house cat she be, e b like say if I free am for outside, another catgo scatter am anyhow, she go return house look like she don chop wowo lick plate!!



Chaiiii - God dey ooooo smiley



As you don read my topic finish, if u wan see more you for add me on here. I also get facebook (Oyinbo Princess) and I dey for twitter too @OyinboPrincess



Videos uploaded weekly on YouTube - subscribe to and watch Oyinbo Princess



ONE LOVE!


0 comments:

Post a Comment